If No Bi For Olamide, Nobody For Know Who I Bi – Adekunle Gold Don Yarn

Naija singer, Adekunle Gold don celebrate his before-before oga wey make am popular.

The award-winning singer, wey headline a show on Sunday, at the 4921-capacity O2 Brixton Academy in London, take time out to appreciate people wey help him on his musical journey.

Make una read wetin the 35 year old singer yarn

“Pheelz, thank you very much. Pheelz got me signed to YBNL. Pheelz, Mr Finesse, thank you very much. And I want to give a big shout out to Baddo, Olamide. I mean without Olamide, all of you won’t know me today. One more time for Baddo, please,”

Leave a Reply