ABOUT

MadamAproko welcome una with salute as you don land for our about page.

My People, No bi say i dey proud, but dis blog na una numba 1 global online pidgin tori(news) carrier wey  go dey nack una ogbonge and latest Informate about People, Things, Event and many many oda tori Matta around the world.

Una go ask me, why bi say na pidgin i choose as my style?

Una go see say English boku berekete, even people wey no sabi speak dey manage dey speak am. MadamAproko come say if English na Queens English, den Pidgin na Kings English because dat na ‘Afrika English’ and dat na our ‘Mother Tongue’

If una go gree with mi say Pidgin dey part of Afrika numba one language wey dem sabi, enter Warri, una go know wetin I mean, even Ghana, Cameroun and Togo dem, dey throway pidgin anyhow.

Hmmm!  Pidgin sweet ooo!  As those wey sabi am go enjoy am, even those wey no sabi go learn sharp-sharp because,MadamAproko don give una license to dey yarn pidgin as no man business for dis blog, sebi una no say Pidgin na ‘Broken’ dis na conbiNATION of all Naija dialect. Yoruba, Hausa, Igbo dey inside Pidgin. So make una leave English alone make we nack our grassroot English bo!

MadamAproko go give una hot hot gist, as una know say “APROKO”  na “PARROT”  and parrot no dey shame to talk wetin im see, so as the gist dey enter, she go dey sama una.

Finally, finally My people, una neva miss road as MadamAproko go totori una well well with her tori.

If una get suggestions, ideas, or una get Amebo wey una wan tell us carry-go! Call :08114226918  or you email us at tori@madamaproko.com
madamaprokoBefore i comot,  make i yarn you small about myself. My name na Moses Anuoluwapo. I bi Bowen University Mass communication graduate. I bi ogbonge Writer, I love small small pikins dem and i call any one wey i c “smallie”  cos misef get small stature. I get innocent face but i stubborn well-well. *team capricon *lolzzzz!

Wen it come to tori matta i no dey take am joke o. Dis Entertainment swagger dey inside blood as i inherit am from my papa. My focus na to reach out to many many people as possible.