DALUNG DON PROVOKE GIVE NFF ON TOP SIASIA SALARY

The oga minister for Sports for Obodo naija, Solomon Dalung don vex give Naija Football federation on top the salary of before before U23 coach of Naija, Samson Siasia.


He don sharpally knack dem provoking memo say make dem find money to clear the debt wey dem dey owe the man.

Samson Siasia before now don carry matter go press say the kind treatment wey Minister of sports and NFF give him U23 side dey part of why them no fit win gold medal for Olympics.

Siasia complain say nobody welcome them from Brazil say them try as them be the only side wey win trophy for obodo naija before one Japanese philanthropic billionaire carry £390,000 give the whole team.

Siasia don resign from Naija job because he say the administrators no serious at all with footballing matter for naija.

Leave a Reply