Skye Bank Don Sack 200 Of Im Staff

Nawa o!!!
Una no dey obey una government again? After government people dem, don beg una make una no sack people wey dey work for you, una stil no hear word!

Ecobank don sack 1040 staff, Diamond bank too sack 200 staff, Skye bank too don join dem for sacking and na yesterday wey bi monday, na im dem too sack 200 people.

Tori yarn say, as the people resume for work, dem no allow dem sidon before dem put sack letter for their hand.

Hmmm!  My people where Naija dey do abeg? Everything don dey become jaga-jaga o, upon say una don increase evrytin, job no dey,  yet una stil dey sack the few people wey get job.
Shey na till hungar wire us before Buhari go do something?

Leave a Reply