2016 NYSC Batch A (Stream II) Orientation Go Begin Nextweek

All una Batch A Stream II Corps members wey dey mekwele for house, NYSC Management don yarn una say, Oga Patapata, Presido Buhari don release funds and im don aprove make una begin the Orientation.


The orientation go begin on Monday 13th June to Wednesday 29th June 2016, all over Naija.

So dem don yarn all of una prospective Corps members say, make una go log for NYSC Portal, so una begin to dey print una Call-up letters from today, Tuesday (7/6/16) by 12noon, because the Call-up letters wey una don print before don become useless o!

Leave a Reply