To Dey Post Account Details Online Dey Evil – Actress, Eucharia Anunobi Don Blow Hot

Eucharia Anunobi, wey bi popular Nollywood actress, don criticise those wey dey post their account details on social media to dey beg money from fans and friends.

This na after popular singer, Davido start the trend few days ago as im post his account details to challenge his friends to send him money, some celebrities like Kunle Remi, Mercy Eke, Pere Egbi don follow the trend and start to dey post their account details on social media to beg for money.

Make Una read wetin the 56-year-old actress write:

“The love of money is said to be evil not money rather what is evil is doing anything shamelessly and negatively to get money

“You are following a trend soliciting for money when that money is not to help the helpless, how gross!

“Putting up your account numbers to get money when you’re not doing anything to help humanity is evil.”

Leave a Reply