Make Una Stop To Dey Use My Picture On Souvenirs, I No Bi God- Pastor Adeboye Don Yarn

The General Overseer of the Redeemed Christian Church of God (RCCG), Pastor Enoch Adeboye, don warn im members of im church dem make dem stop to dey use or buy im and im wife, Foluke, picture for souvenirs wey dem sell say im no bi God .

Im give the warning on Friday December 7th for the annual Holy Ghost Congress of the church wey dem do for the Redemption Camp, Lagos-Ibadan Expressway.

Make Una read wetin im yarn
“It has been brought to my notice that people are using my picture and that of my wife on key holders, calendars, books and other souvenirs. This is wrong and anyone found with such materials should be arrested and reported to the police. I am not God. I did not send them. I have nothing to do with those materials. I am an ordinary man of God. God will never share his glory with any man. I am not ready to die. Devil, I am not ready to go.
If at any time, God is sensing that a man is trying to share his glory, the man is dead. If you find anyone selling anything whatsoever with my picture or my wife’s, report them to the police immediately.”

Im kon yarn the woman buy key holder wey get his picture and his wife on it and give am to im pikin, say thetpikin kon  begin to eat the key holder, naso the picture on the key holder remove and dem kon find the picture of  Prophet T. B Joshua.

Leave a Reply