Dis Na Serious Sumtin O! Grandfather Don Rape Im 3 Grand Daughters

Mothers i take God beg una, no trust anyone at all with your pikin, Abeg.

One Naija mother dey cry out after her father-in-law don rape all her there daughters she left with him to take care.

She yarn say she decide to leave her daughters, wey their age bi 5, 7, and 9, with their grandfather since holiday lesson never start, But she come home from work to see say all of the pikins dem dey cry.
When she ask wetin happen, they tell her say “grandpa was climbing them one by one”.

Dem carry the children go hospital where doctor don reveal say her eldest daughter fit no be able to born again because her reproductive organs don damage.

Leave a Reply