Police Dem Don Arrest One Driver Wey Carry Company Moto Run.

Police don arrest one 30year old man, Jimoh Taoreed, wey disappear with im company moto wey dem dey use distribute purewater for Anglican Diocese, Bodija Ibadan.


Tori yarn say e never reach 24 hours wey dem employ am na wen im run, say wen im apply for the job, im tell dem im name na Saheed Popoola, say im bi indigene of Eruwa town in Ibarapa. Dem com yarn say na after dem arrest, dem discover say im real name na Jimoh Taoreed and im com from Irawo Owode for Atisbo Local Government.

Leave a Reply