FINALLY – FINALLY DREAM TEAM DON SAVE NAIJA FROM OLYMPICS SHAME

The Dream Team VI wey Samson Siasia dey coach don finally carry medal to save the image of Naija.

Team Nigeria no try at all for events like Basketball, Rowing, Wrestling, Athletics, Long jump, and others.

Fear don begin catch Naija when Dream Team VI wey Germany beat 2-0 for semi final come  concede 2 goals after dem don begin lead for the third place match against Honduras.

At last, Mikel Obi captained side carry hope give Naija because the Bronze wey dem win be the only medal wey Naija get for this year Olympics.

Untop this matter, plenty Naija people don dey para on top the lackadaisical attitude of the Minister and the Ministry of Sports.

Leave a Reply