We No Dey Allow Post UTME Examinations Again – FG

Minister of Education, Adamu Adamu, don announce say post UTME examinations wey various Universities dem, organize for dem prospective students who don  pass JAMB no go dey again.

Him yarn say, Federal government get big confidence for Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) dem, so no nid for post JAMB agin.

He yarn dis, as he dey tallk for 2016 Combined Policy Meeting on Admissions to  Universities, Polytechnics and other higher institutions for Naija.

Him com say, from now on, plenty room go dey for students to enter school as JAMB authorities dem, don put the cutoff mark for their admission into all Tertiary institutions at 180.

Say no institution go, go below 180 this year, except University of Ife, University of Ibadan and University of Lagos wey go bi 200 because dem get strong head, dem no go wan gree to the matta .

Leave a Reply