Naija People Go Beg APC Make Dem Continue For 2019

Naija people, una don hear?
Former Minister of Informate, wey don bi APC chief Prince Tony Momoh, na him yarn una this tori o!

Him say Naija people go beg APC to continue for power in 2019.

See wetin him yarn

“I dey yarn una, una go soon jolificate with us,make una give us a year or 2.
Infact by 2019, una go dey beg us, make we continue to dey power una.

For 2019, if we don get thousands of people wey don get job,  wey don dey empowered, with the economic programme wey we dey plan, una no think say those people go happy to vote for us?

Na why I dey beg una make una dey patient, i no say things hard now and e dey pain una, but make una give us a year or two,  una go jolificate with Buhari.”

Leave a Reply