Graphic:Body Of One Family, Wey Don Burn To Death For Ghana

Tori yarn say, seven people one man, him four pikin and two people wey go Visit them don kpemee as fire enter the house for number W.297 at Worakese,  one surburb for Asante Mampong, Ghana.

Them talk say na burglar proof of the house no make dem fit escape, and them neighbours wey evn wan try help dem no see road enter.

Mama landlady, Madam Elizabeth Amoah, yarn tori people say, she bi dey hear people as them dey shout fire!fire!!  She come wake up and see say the house wey  Mr Isaac Botwe, wey bi Estate Officer for Obuasi, his four  pikin and two people wey com grreet dem don dey blow with fire, she com pick her phone call, as she Fire Service for Mampong and Ejura but before them reach the house those people don burn finish.

Tori yarn say the thing we cause the fire,  nobody fit tell.

Leave a Reply