How Oga Buhari, No Go Get Ear Infection? As Una Plenty Wey Dey Shout For Inside Im Ear- Comedian Okon

Popular jingo  Comedian Bishop Imeh wey everybodi sabi am as Okon, yarn funny funny tori for one video for him Instagram.


Im yarn say oga Presido Buhari dey deal with ear infection, say na una Naija people bi the cause, say why he no go get problem for the ear, as more than 160 million people for Naija dey complain inside  the one ear wey Presido get.

 Him com continue say, with all the Kata-Kata wey dey happen for Naija, Boko Haram, Niger Delta militants, Fulani herdsmen, increasing dollar rate, increase in price of tomato, na sure tin make presido ear get problem .

So Okon com say make una pray for Buhari o! Make the infection no enter im second ear, make presido no com becom deaf.
WATCH The Video For Here

Leave a Reply