Na Lie I Lie, I No Kee Person- Blessing Okoro Yarn Critics Dem

Blessing Okoro don take to Instagram to address critics dem wey no wan stop to dey judge her untop the Onye Eze Matta.


The relationship blogger was call out by Mr 2Kay yesterday after she share a post.

Make Una read wetin 2Kay write:

No be this girl wey use the stone them throw her take build mansion?”

Blessing kon hit back, say,

“even my stone and lie blow pass your entire failed music career.”

After plenty other people don drag Blessing, as dem remind her as she claim Onye Eze’s house as her own .

Today, she release a reply for her critics as she share a photo of her in a t-shirt wey get caption say.:

Na lie I lie I no kill person.”

Blessing Okoro

Leave a Reply