Super Eagles Dem Go Get $95,000 Each If Dem Win For AFCON 

Naija Super Eagles squad go get $95,000 bonus each if dem win the 2019 Africa Cup of Nations in Egypt.

Them don already win themselves $10,000 untop say dem beat Burundi on Saturday with 1-0.

Dem also guarantee dem $20,000 if they win their remaining Group B matches against Guinea and Madagascar.

If dem record another victory in the round of 16, the players dem go receive $12,500.

Victories for the quarter-final and the semi-final also go see Gernot Rohr men go get $15,000 and $17,500 , and a win for the final go make the three-time AFCON winners dem earn a $20,000 match bonus each.
“Group stage wins: $10k; Round of 16: $12.5k; QF: $15k; SF: $17.5k. And if they win the final: $20k. So, each player dem go earn $95,000 for winning AFCON2019,”

Na  one member of the Naija Football Federation’s Reforms Committee, Osasu Obayiuwana, yarn dis tori to Sports Extra.

Im add say  Rohr go earn twice the amount of wetin im players  go get, and the goalkeepers trainer and assistant coach Alloy Agu and Imama Amapakabo go receive 75 percent of any amount of wetin  Rohr  go get.

The backroom staff dey entitle to 75 percent of wetin the players dem go earn.

Leave a Reply