Make Una See As Politician For Lagos Slap BBC Reporter Wey Dey Record Am As Im Dey Buy Vote

Segun Adewale wey be popular politician for Lagos wey pipo sabi am as Aeroland slap BBC tori pesin wey dey record as e dey buy vote.

For di polling booth wey dey Pleasure bus stop area of Lagos-Abeokuta expressway, BBC Pidgin reporter see as oga Segun Adewale wey pipo dey call Aeroland, dey give voters N1,000 afta dem don vote finish. Im tanda for one corner dey give pipo di moni afta dem vote finish.

As im see say our tori pesin dey see wetin im dey do, Adewale come attack di BBC reporter. Im slap our reporter as im thugs too collect her phone. Na di police wey dey dia come helep di reporter to collect her phone back. https://bbc.in/2EJw8SW #BBCNigeria2019 #NigeriaDecides2019 #ElectionNotWar #LagosDecides2019

View this post on Instagram

See wia Lagos politician Segun Adewale AKA Aeroland wey dey buy vote tear BBC reporter slap . For di polling booth wey dey Pleasure bus stop area of Lagos-Abeokuta expressway, BBC Pidgin reporter, Ajoke, see popular Lagos politician, Segun Adewale wey pipo dey call Aeroland, as im dey give voters N1,000 afta dem don vote finish. Im tanda for one corner dey give pipo di money afta dem vote finish. . As im see say our reporter dey see wetin im dey do, Adewale come attack di BBC reporter. Im slap our reporter, as im thugs too collect her phone. Na di police wey dey there come helep di reporter to collect her phone back. . Adewale na one Lagos politician wey don try be Ekiti State governor before. #bbcnigeria2019 #nigeriadecides2019 #electionnotwar #nigeria #bbcnewspidgin #bbcpidgin

A post shared by BBC News Pidgin (@bbcnewspidgin) on

Leave a Reply