Serena Williams With Im Fiancé Don Welcome Their First Pikin

Ogbonge Tennis player , Serena Williams with im fiancé, wey bi the co-founder of Reddit , Alexis Ohanian don become daddy and mummy.

Tori yarn say na baby girl! And she born the pikin Friday 1st September, St. Mary’s Medical Center, US after dem induce Serena make she take enter labour for Thursday night.
WPBF-25 news producer, Chris Shepherd na im announce dis tori for Twitter.
Dem also yarn say the baby girl dey weigh 6 pounds, 13 ounces.

Leave a Reply