See As Leicester City Fan Shook Chelsea Fan Bottle For Niger State Untop Football Match

Nawa o,  wetin football go cause enh!!! One 28 year old bobo Nasiru, shook im friend Aliyu bottle untop football match for one viewing centre for Hausawa, Madalla, Niger State.

Tori yarn say the matta happen for Saturday, October 15th, wen dem dey show Premier League football match between Chelsea and Leicester City , wey the scores come bi 3:0.
Naso  argument com start between Nasiru Yahaya, wey bi Leicester City fan and Aliyu Saidu, wey dey support Chelsea .
Dem say the two friends dem don bet with N500 untop the match, but as Chelsea com win Nasiru, com refuse to give Aliyu the N500.
The mata come turn scater scatter, wey come make Nasiru run to one shop, carry bottle, break am and com shook im friend for im hand and back.

Thank God say im never die sha,  as im dey hospital dey collect treatment.

Leave a Reply