Waka –Waka Man Award (Prt 2)

Una welcometo the second leg of our matta between our presido and the ogbonge kabiyesi, Ooni of Ife over who sabi waka-awak (travel)pass. READ HERE

I remember say I yarn una say we want to give the best waka-waka man to one of them but now, tori don change, as una know say we dey era of change, so anytin fit change at anytime.
So we don change our mind for three reason
1. Oga presido dey for sick leave
2. The ancestors dem don warm kabiyesi,say the fowl-leg wey im chop don do
3. We dey look for sponsor for the award nite.
So the waka-waka man award (WWMA) don dey for cooler, but we still get oda award berekete for our event store house.
Among the award wey we wan dash people na:

1. Stubborn Gov. Award(SGA)

A) Gov. Peter Ayodele Fayose – Ekiti State
B) Gov. Wilson Wike- Rivers State
C) Gov. El-Rufai – Kaduna State

2. Coconut Head Senate Award ( CHSA)

A) Dino Meleaye –Kogi State
B) Sheu Sani – Kaduna State
C) Udume- Borno State

3. Lazy-Lazy Minisita Award  (LLMA)

A)Babatunde fashola –Power and Housing
B)Rotimi Ameachi –Transport
C) Kemi Adeosun-Finance

4. Toothless Bull-Dog Award ( TBDA)

A) GeneralTukur Buratai
B) Idris Ibrahim –inspector Gen For Police
C) Nnamdi Kanu – IPOB

Make i stop here, we still get plenty-plenty award ,if you wan bi sponsor and you no want us to radio your name ( silent sponsor)or you want us to blow your trumpet ( Tuwaleh sponsor) make una contact us @ tori@madamaproko.com or make una call 08023818635
I stil dey kampe, I bi your ogbonge big bros

Leave a Reply