Correct Matta: Democrazy Day

My people I salute una courage for dis suffering and smiling period of democracy , we go survive if we no stop our cry-cry to baba God.


18 years of democracy no bi wasa ,even wen a child don reach the age of 18 years im don become semi-adult.
PDP don rule us for16 years,now power don change hand as APC don dey rule for 2 years now, so 16+2= 18,sebi we don mature? from Goodluck Jonathan to Sai baba and from PDP- POWER to APC- CHANGE.
The Nascent democracy don become nonsense democrazy, naso-so promise, promise and fail. No food, no light and no correct hospital.
On any democracy day, we stand gidigba, weda may 29 or june 12,democracy na democracy.
Our politician dey grow fat belle and thick neck everyday, we the voters dem,  dey grow kwashiorkor body and thin neck. Very soon we go commot go vote dem again inside rain and sun, abeg wen the time come, make una shine una eye-o.
Our mumu don do –the afro beat king Fela Anikulapo don yarn us Before-before say pope na igbladun,imam na enjoyment, so  politician for naija na jollification.

Democrazy for Naija still dey for one spot e tanda like lake chad water. I go gba brake here small,till we see again name, ur ogbonge man.
I say Hapi Democrazy Day

Leave a Reply