CORRECT MATTA :Untop Kemi Olunloyo Sharp Mouth/ Inspector-General Of Police Over Sabi Matta

My country side people, how una dey?
Una don collect una CHANGE?
APC transport limited promise us CHANGE,  so make sure una see the conductor for APC motto(Buhari)  for your own change before una drop dead.

Hmmm!  Make i yarn small for Kemi Olunloyo matta with Pastor E. A Adeboye, the matta bi like that tori for inside Bible  for 2kings2:23-24.
Yoruba people say-“Omode bu Iroko o boju wo eyin”(pikin wey curse Iroko tree and e dey look back weda the Iroko tree go reply).

Kemi @hnnafrica no suprise me, na like father like daughter, so her matta na chikini, e no get weight.
I dis writer don kata with her father before in the 80’s wen i dey with punch newspaper, so she inherit am from her papa.
Hm! Man of God Abeg forgive her because she no no wetin she dey do.

Anoda thing we dey disturb me na the behavior of the current Inspector-General of Police, Ibrahim Idris wey wan impress oga Presido Buhari say im too dey fight corruption.
From time Imo river, we never hear say IGPs dey expose their yansh for public, but dis oga of police dey misbehave.
E never reach 2days wey im enter office, e dey give order say all police from Inspector to General must to declare their assets.
Till today dem shun am off, say im dey yarn nonsense.

Again, sombody give you handover letter, you no even care to look and study the letter well well before you open mouth call am thief and declare am wanted.
E show say you Mr Idris no sabi your job sam-sam.
I beg sir,  e go gud make you go for Human Relation course o!
Arase supose to charge you for assault and deformation.
Please go tenda letter of apology quick-quick.

Na mi! Your ogbonge big Bros

Leave a Reply