CORRECT MATTA : Who Go Collect The Highest Waka-Waka Award Between Oga Buhari And Ooni Of Ife?

Dis na the question wey everybodi dey ask

I taya o! Dem say Oga Patapata Buhari don chop fowl feather as im dey fly-fly about from one country to another.
One year wey im don sidon for president, im don fly go 20 country, untop say im wan comot the yama yama wey brother Ebele Jonathan and him jomo’s take rub dis country for oversea,  overair and even self for overland.

But the media talkative, d man wey dey polish oga image, malam Sehu Garuba yarn say our presido waka waka and fly fly navto bring beta wey dey for okoro soup, im say very soon investors go dey bring money yafu-yafu.

Hmmm!  Anoda person wey no dey sidon for one place, wey im and oga Buhari dey waka like tolotolo na the new Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi.
Dem say the Oba na real Johnny walker,  make him te slow, abi im too wan commot the yama yama wey before – before Ooni take rub im palace?

As royal and traditional father, make im sidon coole, make e no dey poke face for everything.

Well sha, i no blame the Kabiyesi, cos young blood still dey im body,  so im free to Waka-about jere but i hope say im dey take permit from Oracle o!

So my people, the highest waka waka award winner na……..
I no go tell una,  make una wait till end of the year.

I remain your ogbonge (Big-Bros)

No Responses

Leave a Reply