Governor Fayose Share Ado-Ekiti People Im Birthday Cake And N200 Each

Ayodele Fayose wey bi Ekiti state governor wey jus become 56 years old on Tuesday November 15th, enter street and begin dey share birthday cake and N200 each to im people for Ado.

Im yarn say na show of love to im people, as im no want make dem jus sidon for government house dey enjoy and im no go remember im people.

Say im collect plenty gift for im birthday, cakes, yam tubers, cows, rice etc but how many im fit eat? How many clothes im wan wear?say na y im take am as normal tin to enter street and dey give to im people wey make am possible for im to become Governor ,say na im style bi dis as im no dey form as im giving dey flow naturally for im.

Leave a Reply