Hunger Dey Wire Naija People – Fayose Yarn Buhari

Ayodele Fayose wey bi Ekiti State Governor,don tell oga Presido Mohammadu Buhari say too much suffering dey for Naija and Hunger dey wire Naija people.


im com yarn say make Buhari try listen to the crying of the people and make im also listen to those people who get brain pass am fod country management, say make im no dey see those people as if dem wan collect thd sit for im hand.

Im say bag of rice wey less dan N8,000 Before-before, but as Buhari enter office the thing don pass N20,000!
Say how civil servant wey dey collect N18, 000 minimum wage go survive

Leave a Reply