My New Song, Na For People Wey Never Marry Like Mi-Banky W

The Ogbonge popular jingo musician Banky W, don release new song! “Gidi Love”  im yarn say as e no fit say Good morning for social media , people go ask am wen im go marry.


Say im know say, No bi only im dey suffer the hot pepper soup ,say many many other single people , dey collect yabbis make dem go marry by fire, by force.
Im com say, No bi say some of “us”no wan marry,  say na just because some of dem never ready or some of dem never meet the person wey dem wan marry.

@Bankywellington com yarn say na the go and marry  tori ginger im swagger to sing im new song “Gidi Love”  say the song na to defend all the people wey never marry like him all over the world.

Make Una Go Download Am.
https://soundcloud.com/bankyw/gidi-love
https://www.hulkshare.com/qc7ornta23uo

Leave a Reply