One Ebonyi House Of Assembly Member Wey Collect Tear Rubber Moto Yarn Say She Wan Sell Her Own

Maria Ude Nwachi, wey bi Legislator for Ebonyi State House of Assembly, wey bi part of the people wey collect tear rubber Prado SUV wey their Governor, David Nweze share on Thursday, Check Am Here

yarn say the moto na baddest, say e dey tempting, mega hot, soooo sooo yum-yum…but dat as the moto dey tempt her reach she no go drive am, but she go turn the moto to liquid for Afikpo people.

Marie say she know say the moto na their official entitlement, as dem dey do for oda states, but she plan to sell her own and use the money give loan and helep those people wey need money to start business, do invest for her  projects and kip the remaining change wey bi  (200k) and use am for herself, say she go personally chop 200k of the liquid, and what she go use am for na to buy Plenty-Plenty wax/ankara, sow  plenty plenty wax gowns and wrapper/blouse.
Say she too wan catch fun as body no be fayawood.

Leave a Reply