If I Catch My Husband With Another Woman , I Go Cut Im Ears And Throat For Sleep – Before-before France First Lady

Dem ask Carla Bruni, 48, wey  bi wife to before – before president of France, Nicolas Sarkozy, 61, say wetin she go do if she find out say her husband dey unfaithful to am, if she see im with another woman.

She com yarn say ‘ she go like cut him throat or him ears when he don sleep, say cheating na dangerous  thing and e fit cause break up.

 Say why person go dey cheat and lie wen the person get opportunity to choose im life im self,  weda im go get married or weda im no wan marry, weda im want pikin or weda im no want’

Hmmm! Oga Nicolas you beta hear wetin your wife don talk oh!  Make you no lose your ears.

Leave a Reply