Christians Go Begin Dey Defend Themselves – CAN Don Provoke Untop Abuja Early Momo Preacher Wey Kakutu

Christian Association of Naija don release statement as dem dey para untop the Abuja early momo Preacher wey die as dem suspect say na muslims wey bi fanatics go do the job.


For the statement dem yarn say make Christians dem prepare to dey defend themselves,say na sad tori as na only Christian dem dey kill,  say dem kill Mrs. Eunice Elisha for Kubwa, Abuja, about a month ago for Kano, dem kill Mrs. Bridget Agbaheme, wey bi 74 year old Christian for Wambai market untop say she tell one Muslim man wey come do ablution for the front of her shop, say another one happen just last week, as dem kill a clergy of the Evangelical Church Winning All (ECWA) Reverend Zakariya say, Fulani Herdsmen for Obi LGA of Nasarawa state,  go attack the man for im farm, and cut im for arm, leg, then dem com cut his head.

Dem say many many other tori wey don happen but make government wake up and use common sense to stop the everything wey dey happen.

Leave a Reply