Anybody Wey Dey Waka-About Dey Sell For Lagos Or Anybody Wey Buy Market From Dem, We Go Sama Dem N90,000 Fine Or Six Months Jail Term – Ambode

Hmmm!  If you never know or you never hear, hear now ooooooo!
Lagos State Governor,Akinwunmi Ambode don knack new enforcement law.

The Governor, wey dey sympathize with the family of one Waka-about seller wey Kakutu as truck jam am as she bi dey try to run so   Kick Against Indiscipline (KAI) people no go arrest am for Maryland Bus stop on Wednesday,  say, im regret the thing wey happen, say no bi for their DNA make dem allow someone  just Kakutu for road accident .

Im com yarn say, State Executive Council don enforce Law, which go affect Waka-about sellers and the people wey dey buy market from dem, say if dem catch anyone of dem, both of the people dem, go pay N90, 000 or dem go sama dem  six month jail term.

Im com say, him and his people dem go dey shine thier eye like tourch light to dey watch waka about sellers and anybody wey buy market, say na just scapegoat dem dey find, say some of dem sef,  na fake fake tins dem dey sell for people.

Hmmm!  My peopulu, make Una no buy, gala,  lacazera, plantain chips, or other thing for traffic from from now ooo!

Make una beware! No become Lagos State Government scapegoat.

Na Governor Ambode dey warn una.
Eko Oni Baje O!

One Response

  1. Anonymous

Leave a Reply