Pastor For South Africa, Dey Use Im Moto Match Untop Im Church Members Body

Nawa ooooo!  I no sabi wetin i wan call dis tori.
But mi i believe say dis Prophet Penuel, don use juju brain wash dis him members o, cos mi,  i no fit stay for dis kin church.


Even as i see the pastor sef,  i no tink say him dey for him right sense,  cos person wey dey him right sense no go do dis kin madness.

South African govt una sure say he never use juju for una too? Cos i no no why una go look am sote him go dey do all this rubbish and una no fit sama am prision.

Na dis same prophet dey give him church members grass, clothes, weavons,etc naje dem chop
 Na him again dey ask him members make dem lie down for ground , he com drive im moto dey climb dem.

 Tori yarn say, na for crusade wey him  organize for Kameelrivier B stadium hall for South Africa dis tin happen.

Leave a Reply