I Don Go Indefinite Strike-Ayo Fayose

Ekiti state governor, Ayo Fayose, don yarn say im don go indefinite strike, as im state civil service dem too don go indefinite strike as him no fit pay their salaries.


Na yesterday him yarn dis tori say:
“I  bi wan yarn my workers say meself don go indefinite strike with unna.

The pain wey una dey feel,  i dey feel am too but i no fit give una wetin misef no get.

As i dey so, my too hand don cut, na why i no fit take my hand do anything for una.

 I dey beg una make una remember your state o!  Na all of us dis matta dey shake.

 Una know say, the time wey i first do first term, I mean, 2003 to 2006, I bi dey pay una  salary  by 21st of every month.

But as the matta bi so, make we all try learn how we go all manage till the matta change for beta.

With all the many many tori wey i don yarn enh, the koko bi say I bi dey expect una, make una com back to una offices.
I go sidon wait for all of una.”

Leave a Reply