NAIJA PRESIDO, PMB BODY NO DEY ALRIGHT.

This tori from premium times, dey fly like pigeon say our oga at the top, the one and only presido Muhammadu Buhari dey strong but e no dey kakaraka.

De aproko from Presidential Villa yarn say de sickness hold oga for throat, sotey im no fit do all de official wakaabout, as una go notice, the Lagos and Rivers waka-waka na Vice Presido Osinbajo carry am for head.

Them talk say the presido dey suffer from hearing well, dis wicked disease na infection dem call Meniere. We sha thank God say no be Zika disease!
For now, Oga special doctor and ogbonge Idibia wey dey dis country don rush go Aso Rock to try their luck as de Elders talk say “doctor treat, but na God dey heal”.
We pray for Oga Buhari quick recover.

Leave a Reply