E Remain Small My Life For Don Destory – Waje

 Aituaje Iruobe, wey everybodi sabi am as Waje, yarn us say e remain small make her life destroy by all this cyberbullies dem. She  yarn say,  the day wey worse pass for her life na the day she become popular jingo for social media.

  Say the popular jingo wey she com bi dat day sef na for bad thing wey almost cause Kata-Kata for her life and music carrer.

She yarn say that day, na after one performance for Guinness Colourful world event for October 2013.  Say after the show, she bi dey expect make people hail am, say she perform well, instead, she collect heavy heavy yabbis  untop her body size, dem dey yab am say she fat.

She Say, dem start to compare her with many many ugly things, Someone sef say she resmble remote control.

She com continue to yarn say,  as she com dey see all the yabbis that time, she cry her eye comot, naso she kukuma begin to dey drink, say she come think am say music na no go area for her make she find sum no fitsomething else do.

Leave a Reply