I Wan Remarry And Born Pikin-Khloe Kardashian

Khloe Kardashian wey just file for divorce from her before-before husband, Lamar Odom, don yarn for one family reality TV, wey she and her family dey do, say na cause she wan remarry and wan born pikin,  na why she divorce Lamar.

She say, Lamar love dey totori her mind well-well,  and she want the thing wey good for him,  but she wan move on and forget the love wan tin-tin wey dem get because she wan remarry and get pikin.
Say the divorce hard for her,  but she must do am.

Leave a Reply