Because Of N50bn Gbese AMCON Don Put Leg On Jimoh Ibrahim Company And Im Money Wey Dey Bank.

The Federal High Court wey im body dey Lagos don say alele to NICON Investment Limited, Global Fleet Oil and Gas Limited and the Ogbonge business man Jimoh Ibrahim, say make e no touch kobo from dis company dem for now.

Na the body dem dey call Asset Management Corporation Of Naija (AMCON)  carry the matta go court.

The matta don become yam pepper scatter-scatter as AMCON say the man Jimoh Ibrahim dey owe dem N50bn.
AMCON  com say all dis im company wey dey for Lagos, Abuja, Dubai even London and all im money wey dey every bank for Naija don become their own till futher notice.
Dem yarn say Jimoh Ibrahim don enter the same trouser with dem, as pikin wey say im mama no go sleep,  im too no go sleep.

Leave a Reply