As Hunger Wan Comot My Eyes, I Kukuma Go Back To Dey Steal – Robbery Suspect

One 23 year old robbery suspect, Jelili Bello,  yarn say, him go back to dey steal people things as hunger wan comot him eyes.

Him say wen im come back from prison in 2015, as dem don catch am before, Im no com fit locate him gang members, wey dem take do operation together, Im com form  new gang with im friend Tomisi. “
Jelili yarn say dem don steal  five motorcycles and dem don sell am, say dem get person wey dey help dem sell for Idi-Iroko.
Say the person go give them N10,000 each after him don sell finsh.
Him say na pepper spray dem dey take do their job.
Him com continue say, No bi only okada we dey steal,  atimes we bi dey pretend say we wan help person carry load,  naso we go carry the load and we go run.

Leave a Reply