APC Leaders, Make Una Go Helep Me Beg Militants In The Name Of God Almighty- Buhari

Oga Presido, Muhammadu Buhari don call leaders of All Progressives Congress (APC) to helep am beg rampaging militants wey dey oil-rich Niger Delta.

He yarn dis for APC leaders dem, for table yesterday wen dem dey chop food as dem dey break the Ramadan fast, say, the militants dem dey cause Kata-Kata and dem dey affect oil installations, say any APC leader wey get friends among the militants dem, to go and beg them in the name of God ‎Almighty to take thing softly, say na difficult time Naija dey so.

Leave a Reply