Wetin Doktors Dem Yarn Untop Ronke Shonde Matta

My people,  una remember Ronke Shonde, mother of two pikin wey tori yarn say her husband brush am anyhow, until she waka go yonder for their house in Egbeda some weeks ago.

Hmmm! Doktors for Lagos State University Teaching Hospital (LASUTH) don put eye and nose for this matter to know wetin kill the woman gangan.

Dr. Shoyemi wey him be the pathologist for LASUTH  yarn say na head matter, say water don plenty for her head well well.
He stil yarn say,  Ronke die of respiratory seizure  which mean say,  she suffocate to death.

Leave a Reply