I DON READY TO SHIT N400m FROM THE MONEY WEY I CHOP-Olisa Metuh

Powerful, power drunk former PDP  publicity man Olisa Metuhselah don vex and yarn say he go shit very soon.

One of him family members Gilbert Metu na him yarn dis.
He say their brother no bi jaduda, say im first name na innocent, so make government treat im matter as VIP matta.

Im com talk say oga innocent Olisa Metuh wan commit to abroad for surgery because e no fit breath well as the moni wey im chop too much and e don hook am for throat.

Tori yarn say, government don yari say N400m na chikini money, dem talk say lai-lai say thier x-ray show dem say the money wey dey metuh belle pass N400m.

Leave a Reply