NA POOR NAIJA ACTORS/ACTRESS DEM I DASH JEEP MOTO.. – Prophet Joshua Iginla.

 General Oversight (G. O)  for Champions Royal Assembly,  Kubwa,  Abuja,  don open mouth say im dash out 32 tear rubber jeeps to Naija poor actors/actress.

Shuo!  De prophet yarn say dis car awuff na everi year for im birthday im dey dash dem.

De koko question bi say,  dis Naija-wood actors/actress like Jide kosoko,  Francis Duru,  Alex Usifo, Ngozi Osondu,  Thelma Nwosu,  Kenneth Okonkwo,  estra-esetra,  dem poor???

Dis correct man of God,  finally finally say de tin wey make life sampa no be how you dey live,  but how you dey dash people yafun-yafun.

Prophet,  Abeg chop knuckle ojere!  Dis tori go sweet my belle pass if na everi youths wey dey dat church get job.

Well sha,  me dey com Abuja com carry my own awuf for una church ooo…….  Na me,  MADAMAPROKO to baedt!!!

Leave a Reply