Yomi Fabiyi Wife Don Curse Trolls Dem Wey Mention Her Child After Her Fight With Tonto Dike

Grace Jimoh,wey bi the wife of Nollywood actor, Yomi Fabiyi don fire back for social media users dem wey mention her son when dem dey try to side with Tonto Dikeh.

Yomi Fabiyi share  post on Instagram, to advise Tonto say  make she stop to dey be threats to others online.

Tonto wwy no like  the advice come yabbis Yomi.

Tonto fans also join her to dey slam Yomi and some of them mention Yomi Pikin .

Grace come took to her Instagram Story to warn them.

Make Una read wetin im write:

Please you can drag me and my husband as you want, but please for God sake keep my son’s name out of it. Except if you wish to bury your children with your hand.”

post

Leave a Reply