Na Online I Find Out About My Husband Marriage To Mercy Aigbe – Kazim Adeoti First Wife Funsho Don Yarn

Funsho Adeoti, the first wife of Mercy Aigbe new husband, Kazim Adeoti don drop some shocking revelation.
She yarn say na for social media she hear say her husband don marry the actress, Mercy Aigbe.
She break her silence when she bin dey Warn Mercy Aigbe to stay away from the house wey she build with her husband.
This drama start after Mercy share video of herself for her husband, Kazim house on Sunday.
Make Una read wetin Funsho write.
“@Realmercyaigbe @adekazproduction for the last and final time stop pushing me. Kazim do the needful, pull it down You’ve been warned 12 hours only”.
Mercy no kon delete the poste but kon post another video of herself in the house on Monday.
This come make , Funsho take her Instagram page to share chat with her husband, Kazim, where she warn am to tell his new wife say make she stop to dey make and post videos in the house “she furnish with her own money”.
Make Una read wetin im yarn
“The next time Mercy makes another post in that house that I furnished with my hard earned money and post on social media, my next move will be brutal on this social media towards both of you…100% of everything in that house was furnished by me, the bed you fck her on was purchase by me, Darm you have zero shame”.
“Note to all: Marrying a second wife was never brought to my attention by Kazim, I found out online just like everyone”,

Leave a Reply