UAE Don Lift Travel Restriction On Nigeria, 11 Other African Countries Dem

The United Arab Emirates UAE, don announce say dem don lift  entry and transit travel ban wey dem place on some African countries like Nigeria, South Africa, Kenya, Ethiopia and eight others dem.
Dem Yarn this on Wednesday by the National Emergency Crisis and Disasters Emergency Management Authority (NCEMA).
Dem first put this ban because Omicron variant of COVID-19.
Make Una read wetin NCEMA yarn on Twitter
“From January 29, entry into the UAE for arrivals from Kenya, Tanzania, Ethiopia, Nigeria, the Republic of the Congo, the Republic of South Africa, Botswana, Eswatini, Lesotho, Mozambique, Namibia and Zimbabwe is allowed again,”
Other countries wey dey affected by the ban lift na : Tanzania, Republic of Congo, Botswana, Eswatini, Lesotho, Mozambique, Namibia and Zimbabwe.
Under the new regulations,  travellers dem must to collect  negative COVID-19 PCR test 48 hours before departure and a negative rapid-PCR test for the departure airport, those wey deu travel from Uganda, Ghana and Rwanda will also have to take the three tests.
Dem go test Passengers  on arrival.

Leave a Reply