Yee!!! Gbas Gbos! Who Get This Table Wey Iyabo Ojo Dey Shake???

Naija actress Iyabo Ojo don take her Instagram to Yabbis her Before-before  friend and colleague.

Even though Iyabo no mention name, plenty hints dey for us to fit guess who she dey talk  to.

Make Una read wetin im yarn :


You never cease to amaze me & I’m not surprised bcos you remain number one agbaya in Nollywood … no self respect @ all, you envy the young ones and pretend to Love the ones that you benefit from somehow at the end you still anit loyal o ku ku si ma tun te bo ni be ni ishhhhhhhhhhh
.
After all I did for you 2 years ago to celebrate your bday in Turkey, you still snitched on me giving media fake news that I was in coma for 3 days you wish bcos you knew about my surgery, I knew you hoped & prayed I died …. that’s why you never came to see me afterwards but guess what my God pass you, he is mighter than you, my God disappointed you & your team
.I’m still living girl
.
You are a Witch!! Yes O!! O gba enu ni but guess what I’m that lioness who will always come out victorious no matter how hard you try to pull me down or destroy my name spiritually….. Darkness & Light can never be on the same page & I make bold to say you are a terrible person …….. Back off witch
.
Enjoy your birthday

 

With everything wey she write, e clear say e fit bi Faithia Balogun she dey talk to…

Faithia 49th birthday,  dem celebrate am for Turkey in 2018 and Iyabo Ojo dey there .
Today wey Fathia clock 51,almost all celebs dem dey share her photo to celebrate her. But Iyabo Ojo no do so instead she dey call out “one agbaya in Nollywood.” and na only one female celebrity dey celebrate birthday today, Fathia!!!

Leave a Reply