We No Ban Olamide and Davido Songs O! Na Fake Website The Tori Come From – NBC

National Broadcasting Commission don yarn to clear the tori wey dey waka about say dem don ban five Naija songs.

The National Broadcasting Commission yarn say the tori na from fake website wey dey link to ‘Nigerian Broadcasting Corporation.’
The talk-talk person for the commission, Antia Ekanem, yarn dis for text message wey dem send to Punch for Abuja yesterday night.
Make una read wetin im yarn
“What you saw on that website was fake. It is not from the NBC. What you saw there is ‘Nigeria Broadcasting Corporation’ and not the ‘National Broadcasting Commission,” .

Leave a Reply