The Photo Of Me Wey Dey Waka About Say I Dey Cry No Bi After Supreme Court Cancel  My Election- Emeka Ihedioha

Governor of Imo state, wey dem just commot Emeka Ihedioha, don yarn say the photo of him wey dey waka about say im dey cry no bi picture after the Supreme court nullify his election but na picture wey im snap for one burial wey im attending in December 2019.

The photo go round on Tuesday January 14th  after the Supreme court nullify his election and declare Hope Uzodinma winner of the March 9th state governorship election.

Make Una read  statement release by his media aide AIC Akwarandu.


“The picture circulating online does not in any way represent the mood of the Former Governor, Emeka Ihedioha, while the Supreme Court Judgment was announced.

The pictures was taken on Friday, 20th Of December, 2019, when the then Governor received the body of His departed Commissioner for Environment, Late Hon. Tony Okere, at the Council Chambers”.

Leave a Reply