God Dey Vex For Buhari-Fayose

Ekiti state governor, Ayo Fayose, don yarn say God dey vex for Buhari.


Talk-talk man for Ekiti house of assembly Stephen Gbadamosi, na him yarn dis tori say, Fayose talk am for thanksgiving service wey dem do to jolificate first anniversary of the 5th assembly for Ekiti June 5th.

Hear wetin Fayose yarn“I no bi prophet of doom, but I must yarn una the truth, if i no do so,  i no go fit sleep.

Na dis economic downturn go pull down this government wey Buhari dey lead.

 Make una go write am down. This economy go improve o, but it go don too late for this Buhari government.
Reason bi say God dey vex gan for this Buhari government, this government don shed plenty plenty blood of  many many innocent people. Soldiers go enter house of poor village people shoot them.
 The blood-shedding don dey too much. Una see wetin dem do for that innocent woman for Kano?
I dey yarn una say na God allow dis bad people dem com dis government so that shame fit catch dem; so that everyone go see say dem bi bad people and dem get too many hypocrisy for body.”

Leave a Reply