Lagos State Government Don Seize  Truckload Of Ponmo Wey Get Poison 

The Lagos State Government don Seize  truckload of “Toxic Ponmo” wey dem import into Naija for Ijegun, wey dey under the Alimosho Local Government.

Permanent Secretary, Lagos State Ministry of Agriculture, Dr. Olayiwole Onasanya, wey yarn this tori today for Lagos, yarn say the  Police for Ikotun na dem arrest full load motto wey get “ponmo”, inside.

Im kon note say dem suspect substance wey fit spread Ebola Virus inside the  ponmo, and dem don carry the ponmo go the Ministry outstation for Johnson Agiri Office Complex, Agege so dem fit throwey dem for the medical waste dumpsite for Ewu Elepe, Ikorodu .

Im kon advice say make evrybody dey careful of any food dem dey buy.

Leave a Reply