Another Building Don Collapse For Lagos Island 

E Never reach two weeks wey one building wey school dey for Itafaji kpafuka and kill 20 people wey include children dem, another building don kpafuka again for Lagos Island.

Tori yarn say , the building dey for Kakawa Street.

Dem never record say anybody die or injure, as dem don already mark the building to for demolish and the people wey dey leave the house don already commot.

Leave a Reply